13 “Na una bi salt for dis eart. But if salt nor get taste; how e go bi for pipol mout? E betta make dem trowey am and make pipol mash am.
But who fit chop food wey nor get salt or taste? Or wish kind taste dey for di white part for egg?
Make una put salt for all una korn ofrin, bikos di salt dey show di kovenant between una and God.
Make all of una word dey good and sweet like wetin dem put sugar, so dat una go know how to ansa evribody.
If pipol wey nor dey obey Man Pikin; dey take di kovenant blood make yeye and dey curse di Spirit wey bring grace, na how dia own ponishment go big rish?