21 As Jesus komot from der, e kon si two brodas, James and John, with Zebedee dia papa, dey ripair net inside dia boat. Den Jesus koll di brodas.
Dis na di twelf disciples name: Simon (wey dem dey koll Pita); Andru, wey bi Pita broda; James wey bi Zebedee pikin and en broda John,
Afta six days, Jesus take Pita, James and John (wey bi James broda), go on-top one high mountin.
E take Pita, James and John, wey bi Zebedee two shidren, with am. But bikos of wetin won happen, belle nor sweet am.
At wons, dem leave dia net kon follow Jesus.
Kwik-kwik dem run leave dia papa inside di boat, kon follow Jesus.
James and en broda John, wey bi Zebedee shidren wey Jesus dey koll “Boanerges (wey mean ‘Tonda shidren’).”
Jesus nor let anybody follow am espect Pita, James and John, wey bi James broda.
Simon Pita and Tomas (wey bi twins), with Netanel (wey en town bi Kana for Galilee), with Zebedee pikin and two oda Jesus disciples, kon gada togeda.
E kill James, wey bi John broda, with swod.