20 At wons, dem leave dia net kon follow Jesus.
Elisha go back kon kollect en own melu, kill and kook dem, den e give di meat to pipol make dem chop. So Elisha follow Elijah kon dey help am.
So, I go kwik-kwik dey do wetin Yu kommand.
“Anybody wey love en papa, mama and pikin pass mi, nor go fit bi my disciple.
Den Pita kon tell Jesus, “Look, wi don leave evritin wey wi get kon follow yu! Wetin dey for us naw?”
Jesus kon tell dem, “Make una follow mi and I go make una katch pipol.”
As Jesus komot from der, e kon si two brodas, James and John, with Zebedee dia papa, dey ripair net inside dia boat. Den Jesus koll di brodas.
So wen dem don push dia kenu rish groun for di wotaside, dem leave evritin kon follow Jesus.
E show mi en pikin, so dat I go fit prish about am give Gentile pipol. I nor go meet anybody make e advise mi