But wen I leave yu, God Spirit go karry yu komot sotey I nor go si yu again. If I go tell King Ahab sey I don si yu, den e find and nor si yu, e go just sey make dem kill mi. Dat one nor good, bikos yor savant dey serve God well-well, since wen e bi small pikin.
Den dem tell Elisha, “Fifty strong men dey here with us wey bi yor savants, abeg make yu let dem go find yor oga. May bi God Spirit don karry am go put for one mountin or valley.” But Elisha sey, “No! Make una nor send dem go.”
God Spirit kon karry mi go di east gate for di temple. For near di gate, I kon si twenty-five men, plus Jaazanaya, wey Azzur born and Pelataya wey bi Benaya pikin and di two of dem na leaders for di land.
Di tin whole my hair with en hand. Den for dis vishon, God Spirit karry mi fly go Jerusalem. E take mi go di gate where dem dey pass for di nort side for di temple and one juju wey dey make God vex, dey der.