Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 3:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 As Jesus dey kom out from di wota afta John don baptize am, heaven open and John kon si God Spirit wey bi like dove, stay on-top Jesus head.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 3:16
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God Spirit go dey with am. E go gi-am di Spirit wey dey give wisdom; di Spirit wey dey give knowledge and di Spirit wey dey give good undastandin. E go still gi-am di Spirit wey dey give pawa and di Spirit wey go make am rule well. E go gi-am di Spirit wey go make am fear God and do wetin E wont.


God sey, “Na my savant wey I give pawa bi dis; di pesin wey I choose and I dey happy with am. I don put my Spirit inside am and e go judge di nashons well.


I make kovenant with una sey: I don give una my pawa and word forever and from naw go, make una dey obey mi kon tish una shidren and shidren-shidren, so dat dem go obey mi forever.”


God wey dey mighty, en Spirit dey on mi, bikos E don anoint mi to prish good news give poor pipol; heal doz wey dia heart break; announce make dem release doz wey bi slave and free doz wey dey for prison.


Thirty years afta dem karry us go Babilon as slave, wen I dey stay with my pipol near Chebar River, for di fift day for di fourt mont, heaven open and I kon si one vishon.


As Jesus dey kom out from di wota, heaven open and God Spirit kom down like dove kon land for en head.


Den e kon sey, “Wetin I dey tell una na true word, una go si heaven open and God angels go dey waka up-and-down on-top God Pikin.”


Di pesin wey God send dey tok about God word, bikos God dey give en Spirit to pipol.


from wen dem baptize am, until e go up leave us; make e kon join us tell pipol di trut sey, Jesus Christ don raiz-up from grave.”


Naim e shaut, “Look! I si heaven wey open and I si Jesus Christ, God Pikin, stand for en rite hand.”


Na Jesus Christ kom dis world with wota and blood. Nor bi only with wota, but na with di wota and di blood. And God Spirit bear witness sey dis na true, bikos na God Spirit bi di trut.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ