Di pipol bi like trees branches wey don dry and skata for groun; wey wimen dey gada take do firewood. So, bikos di pipol nor undastand anytin, God wey kreate dem nor go sorry or pity for dem.
E sey, instead of sadnes, E go give joy and happiness to doz wey dey mourn for Zion. Instead of sorrow, E go put praiz song for dia mout. Dem go bi like tree wey God plant by ensef. All of dem go do wetin dey rite and dem go praiz God for wetin E don do.
Dem go bi like tree wey dem plant for near river wey en rut spread enter di wota. Dem nor dey fear wen hot weda kom and dia leaf dey always green; dem nor dey borda if rain nor fall and dem dey always bring fruit.
E shaut kon sey, ‘Make una kut di tree kon distroy en branches; remove en leaf and skata en fruits. Make una drive di animal komot from under am and di birds wey dey en branches!
Oga God sey, “True-true, Judgement day dey kom; e go kom like strong fire. All doz sturbon and wiked pipol go fall and dat day dem go burn die. Both dia rut and branches go burn finish.
E si one fig tree for road kon waka go where e dey, but e nor si anytin plok, bikos na only leaf di tree get. So e kon tell di tree, “Yu nor go ever bear fruit again!” At wons, di fig tree kon bigin die.
E dey kut evry branches wey nor dey bear fruit for my body komot and e dey ripair evry branch for my body wey dey bear fruit, so dat e go bear more fruit.
Make sure sey una dey obey di Pesin wey dey tok to una! Bikos if Israel pipol wey nor gri hear dia oga Moses word for eart nor eskape, how wi go fit eskape, if wi nor gri hear di Pesin wey dey tok to us from heaven?