Yu dey help pipol wey dey do wetin dey rite; pipol wey remember how Yu wont make dem dey live dia life. But wen wi kontinue to dey kommit sin, Yu vex for us. So na how wi wont make Yu take save us?
E knee down for Jesus front dey kry and e kon dey wet Jesus leg with di tears from en eye. E klean Jesus leg with en hair kon kiss dem, den e pour di oil put.
Mary take perfume wey dear well-well, wey plenty rish kwota gallon kon pour am for Jesus two leg. Den e use en hair take klean dem. (Di perfume send kon full evriwhere for inside di house).
Dat evening, for di first day for di week, en disciples kon gada togeda. Dem lock di door for di house wey dem dey, bikos dem dey fear di Jew oga dem. Jesus stand among dem kon sey, “Make peace dey with una.”
Finally my brodas and sistas, make una use happiness dey do tins as dem suppose bi. Make una take heart, dey greet each oda and live togeda for peace and di God wey get love and peace, go dey with una.