Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 28:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 E nor dey here, bikos God don wake am up, just as God promise. Make una kom si di place where e liedan put before.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 28:6
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

As Jonah dey inside big fish belle for three days and nites, na so Man Pikin go dey for grave for three days and nites too.


From dat time go, Jesus kon dey tell en disciples sey, e go must enter Jerusalem where di eldas, priest oga dem and di law tishas go sofa and kill-am, but for di third day, e go wake-up.


Dem go kill-am and for di third day, God go wake am up.” But di disciples nor happy, bikos of wetin Jesus tok.


As dem dey kom down from di mountin, Jesus warn dem sey, “Make una nor tell anybody dis vishon wey una si until God go wake Man Pikin from deat.”


and dem go gi-am to Gentile pipol make dem laf and flog am well-well, den dem go nail am for cross. But for di third day, God go wake am up.”


dey sey, “Oga God, wi remember sey wen dat wayo man still dey for dis world, e tok sey, ‘Afta three days, e go wake-up.’


But e tell dem, “Make una nor fear. Una dey find Jesus wey kom from Nazaret, wey dem kill. God don raiz am from deat! E nor dey here again. Make una look di place wey dem put am before.


Den Jesus bigin tish dem sey, “Man Pikin must sofa many tins, bikos di eldas, di priest oga dem and di law tishas go kill-am and afta three days, e go wake-up from deat.”


But Pita kon get up, run go di grave. E ben-down look inside and e si only di klot, den e kon go house dey wonder wetin happen.


and dem nor si en body for der. Dem kom back dey tok sey dem si angels wey tell dem sey Jesus dey alive.


Den Jesus tell dem, “Na di word wey I tell una wen I still dey with una bi dis, evritin wey dem rite about mi for Moses Law, di profets book and Psalms, must happen.”


Na dis bi di rizin wey make my Papa like mi, bikos I ready to sakrifice my life, so dat I go fit get di life back again.


Jesus ansa dem, “Even if una distroy dis Temple, for three days time, I go build am again.”


But God kon raiz am up afta E don gi-am pawa to win deat, bikos deat nor get pawa to hold am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ