Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 28:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 But di angel tell di wimen, “Make una nor fear, I know sey una dey look for Jesus Christ, wey dem nail for cross.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 28:5
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make una tell evribody wey nor get hope sey, “Make yu dey strong, nor fear at-all! God dey kom save yu and E go ponish yor enemies.”


So make una nor fear, bikos I dey with una! Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear! I go make una strong kon help una and I go protet and save una.


God sey, “Israel pipol, as una small and dey weak rish, make una nor fear, bikos I go help una. Mi wey bi Israel God wey dey holy, na mi bi di only Pesin wey go save una.


Di angel tell mi, “Daniel, make yu nor fear. Since di first day wen yu honbol yorsef kon dey pray for undastandin, naim God don ansa yor prayers. So I kom as ansa to all yor prayer.


E sey, “Make yu nor fear, God love yu well-well! So nor let anytin worry yu. Make yu dey strong! Wen e don tok like dis, my body kon strong more-more.” Den I sey, “Oga! Yu don make mi dey okay naw.”


But Jesus tell dem, “Make una heart strong! Na mi, make una nor fear.”


Den Jesus Christ tell dem, “Make una nor fear, but tell my brodas make dem go Galilee and dem go si mi for der.”


Di guards kon dey shake and dem bi like pipol wey won die, bikos fear katch dem well-well.


But e tell dem, “Make una nor fear. Una dey find Jesus wey kom from Nazaret, wey dem kill. God don raiz am from deat! E nor dey here again. Make una look di place wey dem put am before.


Den di angel tell am, “Make yu nor fear, Mary, bikos God don favor yu!


Fear katch di wimen and dem kon face groun. But di men tell dem, “Why una dey find pesin wey dey alive for where dead body dey?


But God kon raiz am up afta E don gi-am pawa to win deat, bikos deat nor get pawa to hold am.


All di angels na savants and na dem God send go prish for pipol wey go get salvashon.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ