16 So di eleven disciples kon go Galilee for di mountin wey Jesus Christ tell dem.
But afta God don raiz mi up from deat, I go-go Galilee, go wait for una.”
Den Jesus Christ tell dem, “Make una nor fear, but tell my brodas make dem go Galilee and dem go si mi for der.”
Den make una kwik-kwik go tell en disciples sey, ‘God don raiz am from deat and e dey go wait for una for Galilee. Una go si am for der.’ Make una remember sey I tell una so!”
But afta God don wake mi up from deat, I go-go una front, go wait una for Galilee.”
For di time wen Jesus dey Galilee, dis wimen dey follow and help am. Many oda wimen wey follow am kom from Jerusalem, dey der too.
Den Jesus appear to di eleven disciples wen dem dey chop. E shaut give dem since dem nor bilive, bikos of dia strong heart.
Make una go tell en disciples and Pita sey, Jesus don go Galilee go wait for dem. Una go si am for der, as e tell una before.”
Jesus ansa, “Nor bi twelf of una I choose? But one pesin among una na devil pikin.”
So, if resureshon nor dey, dat mean sey, evritin wey wi don tok about God, na lie, bikos wi sey E raiz Jesus from deat wen E nor raiz am.