55 Many wimen wey follow Jesus Christ from Galilee and wey dey help am, dey der too. Dem dey look wetin dey happen for der.
Some wimen dey der dey look from far. Dem bi Mary Magdalin, Mary wey bi Josef, James and Salome mama.
For di time wen Jesus dey Galilee, dis wimen dey follow and help am. Many oda wimen wey follow am kom from Jerusalem, dey der too.