Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 27:54 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

54 Wen di sojas oga and di pipol wey dey guide Jesus Christ si di eartkweke and wetin happen, dem fear well-well kon sey, “True-true dis man na God Pikin.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 27:54
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But Jesus kwayet. Den di High Priest kon tell am, “I take God name kommand yu to tell us if yu bi Christ, wey bi God Pikin.”


Dem sidan der dey look make anybody nor tosh am.


dey sey, “Yu wey sey yu go distroy di temple kon build am back for three days, make yu save yorsef! If yu really bi God Pikin, make yu kom down from di cross!”


Since e trust God, make God kon save am naw, bikos e sey, ‘I bi God Pikin!’ ”


At wons, di temple kotton tear from up go rish bottom. Di groun bigin shake and rocks kon skata for evriwhere.


Den devil kon meet am sey, “If yu bi God pikin, kommand dis stone make e turn to bread.”


Wen Jesus enter Kapanaum, one Roman offisa kon meet am dey beg make e help am.


Wen di soja wey stand for Jesus front si how e take die, e kon sey, “True-true dis man na God Pikin!”


All of dem kon ask, “So, yu bi God Pikin?” Jesus ansa, “Na una tok am o-o.”


Di Jew oga dem ansa, “Wi get law and di law sey, e suppose to die, bikos e sey en na God Pikin.”


One man wey en name bi Kornelius dey stay for Caesaria and e bi offisa for Italy soja.


Wen di pipol hear dis prishin, e trobol dem for mind well-well and dem kon ask Pita and di rest apostles, “Awa brodas, wetin wi go do naw?”


At wons, e karry plenty sojas and ofisas kon run go where di pipol gada. Wen dem si di kommanding offisa and di sojas, dem kon stop to beat Paul.


Paul koll one soja oga kon tell am, “Take dis boy go meet di kommanding offisa, bikos e get sometin wey e won tell am.”


Den e koll two soja oga kon tell dem, “For nine oklok dis nite, make una ready two hundred sojas wey go-go Caesaria, plus seventy, wey go ride horse and two hundred, wey go karry spear.


Wen dem don gri sey wi go travel inside ship go Italy, dem kon karry Paul and some oda prisonas give Julius, one kommander wey dey Augustan group.


But bikos di soja offisa one save Paul life, e nor kon let dem do wetin dem plan. E kommand di pipol wey fit swim, make dem first jump komot from di ship swim go land


and naim bi my only Pikin wey I wake-up from deat with di Holy Spirit pawa.


For dat same time, betta eartkweke go happen and if dem divide di town into ten, one part go distroy finish. 7,000 pipol go die for di eartkweke and evry oda pesin go fear kon bigin tank God wey dey heaven.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ