47 Some of di pipol wey hear di word kon sey, “Dis Man dey koll Elijah make e kom help am.”
Make una si, I go send Profet Elijah kom meet una, before God Judgement Day go kom.
And if una go gri with wetin I dey tok, John, na-im bi Elijah wey suppose to kom.
Wen three oklok won rish, Jesus Christ kon shaut, “Eli, Eli, lema Sabaktani?” wey mean, “My God, My God, wetin make yu abandon mi?”
At wons, one of dem run go bring sponge kon soak am for wine wey don sawa, put am for stik, den kon give Jesus make e drink.