Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 27:38 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

38 Dem still nail two tif near Jesus Christ for cross, one for en rite and di oda for en left hand.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 27:38
10 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So, I go honor and put am for where great men dey, bikos na only en sakrifice en life and dem si am as sina too. E karry evribody sins for en head kon pray so dat God go forgive us.


On-top of en head for di cross, dem rite wetin dem take akuiz am: “Dis na Jesus Christ, Jew pipol king.”


So di pipol wey dey pass where Jesus Christ dey kon dey laf am and dey shake dia head


Di tifs wey dem nail for cross near Jesus Christ, still dey curse am too.


Dem nail two tif with am for cross, one for en left and di oda for en rite side.


Bikos I tell una, wetin dem rite for God word about mi must happen sey, ‘Dem kount am join criminals.’ Bikos wetin God rite about mi dey happen naw.”


For der, dem kon nail Jesus for cross. Dem still nail two oda pipol for cross, one for en rite and di oda for en left.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ