Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 27:32 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

32 As dem dey go outside, dem si one man from Sirene wey en name na Simon and dem kon force am make e karry Jesus Christ cross.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 27:32
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make una arrange two jaguda make dem akuiz am sey, e curse God and di king. Den take am komot for di town kon stone am die.”


Leta, di two jaguda kon akuiz Nabot sey, e curse God and di king, so dem take am go outside di town kon stone am die.


den karry dem go outside di kamp for where dem dey pour ash put, den e go burn dem for der with firewood.


E go karry di melu go outside di kamp go burn am, just as e take burn di melu wey e give for en own sin.


“ ‘If na di High Priest sin kon make di pipol dey guilty, e go give one yong melu wey dey okay to God for en sin.


Den Jesus tell en disciples, “If anybody won follow mi, e must deny ensef, karry en cross and follow mi.


And if anybody force yu waka one mile, make yu follow am waka two mile.


Di sojas kon force Simon, one man from Sirene, wey just dey enter di town, make e karry Jesus cross. (Di man na Alexanda and Rufus papa.)


As dem dey take Jesus komot, dem kon katch one man wey dey kom from Sirene and en name na Simon. Dem put di cross for en back make e karry am follow Jesus.


As Jesus karry en cross dey go, e kon rish di place wey dem dey koll “Di Skull” (na Golgota dem dey koll di place for Aramaik language.)


But some among dem wey kom from Cyprus and Sirene kon go Antiok dey tok to di Greek pipol about di Good News wey koncern Jesus Christ.


Dis na di profets and tishas wey dey di church for Antiok: Banabas, Simeon wey dem dey koll Naija, Lucius wey kom from Sirene, Manaen (wey bi Herod di Tetrak friend from small pikin) and Saul.


Frigia and Pamfilia, even di pipol from Egypt and di aria for Libya near Sirene, plus all di strenjas wey kom from Rome,


But some men kon dey argue with am. Dis men dey woship God for one place wey dem dey koll “Di Freedmen Sinagog.” Some among dem kom from Alexandria, Sirene, Silisia and Asia.


Wen dem don drag am go outside for di temple, dem kon start to dey stone am, den dem kon pul all dia klot give one man wey dem dey koll Saul, make e whole.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ