Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 27:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 Di pipol ansa, “Make en blood dey awa head and awa shidren own!”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 27:25
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

den David tell di dead man, “Na yu use yor mout take kill yorsef: Yu kondemn yorsef wen yu sey yu kill di pesin wey God choose as king.”


God go ponish Joab for doz pipol wey e kill, wey David my papa nor know about. Joab kill two innocent men wey betta pass am: Abner wey bi Israel soja kommander and Amasa wey dey kommand Judah sojas.


Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.


“ ‘If una do like dat, una go spoil di land where una dey stay. Di pesin wey kill pesin dey spoil di land and unless dem kill-am, dem nor go fit klean di land where dem for kill pesin.


Di pesin wey fall for dis stone go skata and di pesin wey dis stone go fall on-top, go grind to powder.


Wen dem oppoz and curse am, e shake en dress kon sey, “Make una blood dey una head, bikos I nor do any bad tin and from today go, I go-go prish for Gentile pipol!”


E ask dem, “Wi kommand una sey make una nor tish pipol about dis name, but si naw, di whole Jerusalem don full with di tins wey una dey tish. Una won put dis man blood for awa head?”


E get any profet wey una grand-grand papa dem nor kill? Dem even kill di messenja wey tok before sey, ‘Di Raitious Man go kom and una go gi-am to wiked pipol and dem go kill-am.’


Una must nor kill innocent pesin for di land wey di Oga una God won give una, bikos dat go make una dey guilty.


Make una nor sorry for dat kind pesin! Pipol wey dey kill pipol wey nor do anytin, make una komot dem from Israel, den evritin go dey well with una.


Anybody wey kom out from yor house, na-im kill ensef bi dat, so dat one nor go bi awa fault! But if anytin happen to anybody inside yor house, den make yu blame us.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ