Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 27:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 Wen Pilate si sey di pipol nor gri and trobol won start, e kon take wota wosh en hand for di pipol front dey sey, “Dis man blood nor dey my head. Make only una go kill-am!”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 27:24
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

My God, I dey live my life well, so dat I go fit kom yor altar


Una wey sey na tree bi una papa and rock na una mama, God go disgrace una. Dis tins go happen, bikos instead of una to follow mi, una kon waka leave mi. But anytime una dey for trobol, una go sey make I kom save una.


una still sey, ‘Wi neva do any bad tin at-all, so God nor go vex for us again.’ But make una look! I go make sure sey I judge una, bikos una sey, ‘Una neva kommit any sin.’


But dem sey, “Make wi nor do am wen di Feast don start, so dat pipol nor go make trobol.”


As Pilate sidan for di judgement seat, en wife send message go meet am sey, “Nor put hand for dat innocent man matter, bikos last nite, I dream bad dream about am.”


Pilate kon ask, “Why? Wish bad tin e do?” But dem kon dey shaut more-more, “Nail am for cross!”


kon sey, “I don sin as I sell dis innocent man make dem kill-am!” But dem sey, “How dat one take koncern us? Na yor business bi dat.”


Wen di sojas oga and di pipol wey dey guide Jesus Christ si di eartkweke and wetin happen, dem fear well-well kon sey, “True-true dis man na God Pikin.”


So wetin profet Jeremaya tok kon happen: “Dem take thirty silva koins, di money wey Israel pipol don gri to take sell Jesus,


So Simon Pita tell am, “Oga God, make yu nor wosh only my leg, but make yu wosh my hand and head too!”


Pilate kom out again kon tell di Jew oga dem sey, “I won bring am kom out for una, to let una know sey I nor si anytin bad wey e do.”


Una sey una nor wont Jesus Christ, di holy and Raitious Pesin, instead una sey make dem release anoda pesin wey dey kill pipol give una.


Di One wey nor dey sin, God make am awa sin, so dat inside am, wi go kon dey good for God eye.


Bikos of sin, Christ sofa. En wey nor do bad, sofa for doz wey do bad, so dat e go karry us go meet God. And wen dem kill-am, e wake-up as spirit.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ