12 Wen di priest oga dem and di eldas dey akuiz Jesus, e nor ansa dem.
Dem trit and ponish am anyhow, but e put body down kon bear-am like lamb wey dem won go kill and e nor tok anytin.
But Jesus kwayet. Den di High Priest kon tell am, “I take God name kommand yu to tell us if yu bi Christ, wey bi God Pikin.”
Den Pilate tell Jesus, “Yu nor hear all di tins wey dem dey tok sey yu do?”
But Jesus nor ansa and di govnor kon sopraiz well-well.
Herod kon ask Jesus many kweshon, but Jesus nor ansa am at-all.
Na di place wey e dey read for God word bi dis, “Dem lead am like sheep go kill and as sheep pikin dey kwayet wen dem dey shave am, na so too e nor open en mout.
Wen dem curse am, e nor ansa back; wen e sofa, e nor treaten sey e go pay dem back, but e put ensef for God hand wey nor dey judge kase with parsha.