71 Wen e komot go outside, anoda girl wey bi savant si am kon tell di pipol wey dey der, “Dis man sef dey with Jesus wey kom from Nazaret.”
Wen e rish Nazaret, e kon stay der. Dis one make wetin Profet Jeremaya tok happen sey, “Dem go sey Jesus, na Nazaret e from kom.”
But Pita deny am for evribody front kon sey: “I nor know wetin yu dey tok about!”
Pita kon swear deny again, “I nor know di man!”
Afta sometaim, anoda pesin si am kon sey, “Yu dey with dem, nor bi so?” But Pita sey, “My friend! I nor dey with dem o-o.”