God tell Moses, “If to sey na en papa just spit for en face, dem nor go disgrace am for seven days? So make e komot form di kamp for seven days and afta, e fit kom back.”
den di woman go waka go meet am for di eldas front kon remove en sandal from e leg den spit for en face. Den di woman go sey, “Make dis kind tin happen to any man wey nor gri keep en broda name for Israel!”
Make wi dey look Jesus Christ wey give us awa faith and go help us keep am. Bikos of di joy wey Jesus dey espect, e sofa for cross and nor mind di shame wey follow am. But naw, e don sidan for di rite hand side for God throne.