But make una dey shine una eye evritime, dey pray make God give una pawa take pass all dis test wey go happen, so dat una go fit stand for Man Pikin front.”
Di ones wey fall for where stones dey, na di pipol wey hear God word kon receive am with happiness, but dem nor get rut. Dem bilive small, but wen wahala kom, dem nor bilive again.
Moses Law nor fit do dis tins, bikos di yeye life wey wi dey live don make di law weak. But God don free us wen E send en pikin kom like human being wey bi sina, make e for sakrifice ensef for awa sins.
E nor get anytin wey dey happen to una naw, wey neva happen to odas before, but God dey keep en promise and E nor go allow una pass thru wetin una nor go fit bear.
With difren prayers, make una dey ask God to help una. Make una always dey pray with di Spirit and dey shine una eyes well-well. Make una nor give up, but make una kontinue to pray for all God pipol.