40 Wen Jesus kom back, e kon si sey all en disciples dey sleep. Den e ask Pita, “So yu nor fit stay make yu nor sleep for one hour?
Ahab ansa, “Make una tell King Ben-Hadad sey, ‘Betta soja nor dey make mout until e fight en war finish.’ ”
I dey sleep, my heart dey dream; bikos I hear my love dey nok and sey: “Open for mi, my treasure and darlin; my dove and di rite pesin for mi, bikos dew don wet my head and dust don make my hair dirty.”
E kon happen sey di man wey won marry, nor kwik kom, so all di virgins kon sleep.
Pita still ansa, “Even if I go die, I nor go ever deny yu.” And all di disciples still tok di same tin.
Den e tell dem, “My heart heavy and e bi like sey I won die. Make una stay here and make una nor sleep.”
Open yor eye make yu pray, so dat yu nor go fall inside temptashon. Yor spirit won do am, but yor flesh dey weak.”
E kom back kon si en disciples dey sleep again; dem nor fit open dia eyes.
Wen Jesus kom back, e meet en disciples dey sleep, so e tell Pita, “Simon, yu dey sleep? Yu nor fit stay make yu nor sleep for one hour?
Wen e pray finish, e go meet en disciples kon si sey dem dey sleep, bikos dem don taya well-well.
Pita and di odas wey dey with am dey sleep before, but at wons sleep komot from dia eye and dem si Jesus glory and di two men wey stand with am.
For morning, before sun kom out, make una attack di town, wen Gaal and en men kom out kon fight una, make una distroy dem finish!”