37 E take Pita, James and John, wey bi Zebedee two shidren, with am. But bikos of wetin won happen, belle nor sweet am.
Afta six days, Jesus take Pita, James and John (wey bi James broda), go on-top one high mountin.
Den Zebedee wife with en shidren, James and John kom meet Jesus. Dia mama kon knee down dey beg Jesus.
As Jesus dey waka for Galilee wotaside, e si two brodas, Simon wey dem dey koll Pita and Andru en broda, dem dey trow net inside di river dey katch fish.
As Jesus komot from der, e kon si two brodas, James and John, with Zebedee dia papa, dey ripair net inside dia boat. Den Jesus koll di brodas.
Jesus nor let anybody follow am espect Pita, James and John, wey bi James broda.
Bikos Jesus dey struggol well-well for mind, e pray sotey en sweat kon bi like blood.
“My heart heavy well-well. Wetin I go tok? ‘Papa, make yu save mi from dis tin wey won happen’? No! Na dis tin make mi kom dis world.