32 But afta God don raiz mi up from deat, I go-go Galilee, go wait for una.”
From dat time go, Jesus kon dey tell en disciples sey, e go must enter Jerusalem where di eldas, priest oga dem and di law tishas go sofa and kill-am, but for di third day, e go wake-up.
and dem go gi-am to Gentile pipol make dem laf and flog am well-well, den dem go nail am for cross. But for di third day, God go wake am up.”
Pita kon ansa am, “If odas run leave yu, mi, I nor go ever leave yu!”
Den Jesus Christ tell dem, “Make una nor fear, but tell my brodas make dem go Galilee and dem go si mi for der.”
So di eleven disciples kon go Galilee for di mountin wey Jesus Christ tell dem.
But afta God don wake mi up from deat, I go-go una front, go wait una for Galilee.”
Make una go tell en disciples and Pita sey, Jesus don go Galilee go wait for dem. Una go si am for der, as e tell una before.”
Den e appear to more dan five hundred bilivers. Some of dem still dey alive, but some don die.