Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 26:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Di priest oga dem and di eldas kon whole meetin with Kaiafas, di High Priest, for en palis.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 26:3
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem dey gada hide dey look mi; dey monitor mi as I dey waka and dem dey ready to kill mi.


Before dis time, I bi like lamb wey dem won go kill, even doh I nor know anytin. I nor know sey na mi dem dey plan dis kind wiked tin for. Dem bin sey, “Make wi kut di tree naw wey e still dey fresh; make wi kill-am, so dat nobody go remember am again.”


But una must obey mi kon make di Sabat, holy. For dat day, una must nor karry any load pass Jerusalem gate, if una do am, I go burn di gate rish round. Fire go burn di palis rish groun too and nobody go fit kwensh am.’ ”


As Pita sidan outside for di yard. One girl wey bi savant kon tell am, “Yorsef bin dey with Jesus Christ wey kom from Galilee.”


Di sojas take Jesus Christ enter di govnor house and all of dem kon gada am.


Pita follow Jesus from far till e rish di High Priest varanda. E sidan with di guards dey warm en body near fire.


For dis time, Pita dey for di varanda, den di High Priest girl savant kom der.


So di sojas push Jesus enter di varanda for di govnor palis kon koll evribody gada.


Wen dem don make fire for di kompond centre kon sidan togeda, Pita sidan with di pipol too.


For dat time, na Annas and Kaiafas bi di High Priests. So God kon tok to John, wey bi Zekaraya pikin, for inside wildaness.


(By dis time, di priest oga dem and di Farisee pipol don give orda sey, anybody wey know where Jesus dey, make e kon tok, so dat dem go-go katch am).


Den Annas kon send am as dem still tie am with rope, go meet Kaiafas, wey bi di High Priest.


Den, dem take Jesus komot from Kaiafas place go di Roman Govnor palis. (By dis time, morning don rish). Dem nor gri enter inside di govnor house, make dem nor for dirty as dia tradishon tok, so dat dem go fit chop di Passova food.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ