21 As dem dey chop, e kon sey, “I tell una true word, one of una go sell mi.”
“Make una know sey na two days remain before di Passova go start and dem go give Man Pikin to pipol wey go nail am for cross.”
Wetin e tok kon worry dem well-well, so dem kon bigin ask am, “Oga God, na mi?”
“Wetin I dey tok so nor koncern all of una, bikos I know di pipol wey I choose. Dis show sey God word na true sey, ‘Di pesin wey follow mi chop don turn to my enemy.’
Wen e don tok dis tin finish, en heart kon heavy well-well, den e sey, “I dey tell una true word, one of una go sell mi give my enemy.”
Di disciples look each oda kon dey worry and tink for dia mind sey, “Wish pesin e dey tok about?”
Nor-tin wey God kreate fit hide from am and evritin dey naked to God, bikos wi go must tell am how wi live awa life.
I go kill all en shidren, den all di church pipol go know sey, I know wetin dey for pipol mind and heart. I go reward evribody akordin to wetin e do.