4 But di ones wey get sense karry estra kerosine.
Yu love wetin dey rite kon hate wiked tins. So Oga wey bi yor God don anoint yu as E pour en oil for yor head kon make yu high pass any oda pesin.
“Si! I dey send una go like sheep for where plenty wiked animals dey, so make una dey wise like snake and gentol like dove.
Five get sense and five nor get sense.
Wen di ones wey nor get sense karry dia lamp, dem nor take estra kerosine follow body.
E kon happen sey di man wey won marry, nor kwik kom, so all di virgins kon sleep.
“Pesin wey hear my word and do wetin I tok, e bi like wise man wey build en house on-top rock.
Di pesin wey God send dey tok about God word, bikos God dey give en Spirit to pipol.
But una nor dey obey sin, instead, na as di Spirit sey make una live, na so una dey live.
and E don mark us as en own kon put en Spirit for awa heart, so dat wi go dey sure of all di oda tins wey E sey E go give us.
But di pesin wey dey holy, don anoint una and all of una know sey na true.
As for una, di Holy Spirit wey Christ give una, dey stay inside una, so una nor nid anybody to tish una again. Evritin wey di Holy Spirit dey tish, na true and lie nor dey inside. Just as e don tish una, make una stay inside am.
Dis kind pipol dey divide God pipol; dem like dis world tins and dem nor get God Spirit.