Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 25:36 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

36 I dey naked and una give mi klot wear, wen I nor well, una kare for mi, wen I bin dey prison, una kom visit mi.’

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 25:36
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make una share una food with pipol wey dey hongry kon open una door for poor pipol wey nor get house. Den give klot to pipol wey nor get anytin to wear and help una own rilashons.


opress or tif from pipol. Dey riton wetin pesin gi-am to take borrow money. Dey feed pipol wey dey hongry kon give klot to doz wey dey naked


Pesin wey nor dey play pipol wayo or tif from pipol. Anytin wey pesin gi-am, so dat e go borrow di pesin money, e dey riton am give di pesin; e dey give food to pipol wey dey hongry and doz wey dey naked, e dey give dem klot wear.


Una nor gri kare for di ones wey dey weak; heal di ones wey dey sick; bandage di sore wey some get; go find di ones wey waka anyhow or look for di ones wey lost. Instead, una dey trit dem with wikedness.


“Den di raitious pipol go ansa, ‘Oga God, wish time wi si yu hongry and dey thirsty, kon feed and give yu sometin drink?


Di time wen I bi strenja, una nor let mi enter una house, wen I dey naked, una nor give mi klot wear, wen I nor well and dey for prison, una nor kom visit mi.’


John ansa dem, “Di pesin wey get two klot must give one to pesin wey nor get at-all and di pesin wey get food must share with pesin wey nor get.”


Like dis, I don show una sey wi must help pipol wey dey weak and una remember wetin Jesus Christ tok, wen e sey, ‘E betta make pesin dey give pipol tins, dan make e dey kollect from dem.’ ”


True-true, una sofa like oda prisonas and una dey happy wen dem seize all una propaty, bikos una know sey una get betta tin wey go last forever.


Make una remember doz wey dey prison, like sey unasef dey der with dem and make una remember doz wey dey sofa, like sey una dey sofa like dem.


But betta relijon wey nor get stain for God eye, naim bi dis: to kare for shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dey sofa bikos dia husband don die. So, make una keep unasef, so dat dis world nor go stain una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ