3 Wen di ones wey nor get sense karry dia lamp, dem nor take estra kerosine follow body.
E know di value for evritin wey e dey make and e dey work go rish nite.
Dem dey woship mi evriday dey sey, dem won know my ways and obey my laws. Dem sey make I just dey give dem my laws, bikos dem dey happy to woship mi.”
Wen e si dia enemies dey kom, e go ring di bell to warn evribody.
“God Kingdom bi like wen ten virgins karry dia lamps go meet man wey won marry wife.
Five get sense and five nor get sense.
But di ones wey get sense karry estra kerosine.
If yu look dem well-well, dem bi like God pipol, but dem don rijet God pawa. So make yu run from dis kind pipol.
Make una make sure sey nobody turn back from God grace and make nobody get bad belle and kause trobol wey go make pipol sin.
“Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Sardis: ‘Di Pesin wey whole God seven spirits and di seven stars: I know wetin yu dey do; for pipol eye, yu dey alive, but true-true, yu don die.