2 Five get sense and five nor get sense.
Na good fig full di first basket; figs wey kwik ripe; but na bad fig wey dem nor go fit chop dey di sekond one.
“Si! I dey send una go like sheep for where plenty wiked animals dey, so make una dey wise like snake and gentol like dove.
“Who bi di savant wey wise and good? Na di pesin wey en oga make leader among di oda savants, so dat e go give dem food for di korrect time.
Wen di ones wey nor get sense karry dia lamp, dem nor take estra kerosine follow body.
But di ones wey get sense karry estra kerosine.
“But dem ansa, ‘No! Wetin wi get nor go rish wi share, instead make una go buy for unasef.’
Na from us dis pipol from komot, but dem nor really dey God family before, bikos if to sey dem dey, dem for stay with us. But dem live us, so dat evribody go know sey dem nor bi awa own.
So I won remind una even doh una don already know dis tins. Afta God don first save Israel pipol from Egypt, e kon distroy doz wey nor bilive am.