14 “One man wey dey travel kon koll all en savants divide en propaty give dem.
“Make una hear anoda parabol: One man plant vine for en farm, fence am round, dig pit where dem go for press di fruit wey dem go take make wine and build where sekurity go stay. Den e rent di farm give farmers kon travel go far place.
E go bi like wen man dey travel go far. E leave en house make en savant look am, give dem work do kon tell di gateman make e wosh en house.
Jesus kon tell di pipol one parabol: “One man rent en grape farm give tenants, den e travel.
Na many spiritual gifts God dey give pipol, but all of dem na from di same Spirit.
Mi and Apollos na God savant and E use us take prish to una make una for fit bilive, so mi and am dey do di work wey God sey make wi do.
Na Christ make some among us bi apostles, profets, evangelist, pastors and tishas.