Den tell am make e nor worry or fear and make e nor let anybody disturb am, bikos King Rezin, en pipol and Pekah vexnashon nor get pawa rish di smoke wey dey kom out from two firewood.
“Man pikin, make yu profesai. Tell dem wetin mi God wey get pawa dey tell Ammon pipol wey dey curse Israel. Tell dem sey: “ ‘One swod dey ready to skata; swod wey dem polish to kill and e dey shine like tonda lite.
Den anoda red horse kom out. Dem give di pesin wey dey ride am, big swod and pawa to take remove peace from dis eart. So pipol kon dey fight and kill each oda for evriwhere.