Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 24:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Many pipol go kom with my name dey sey, ‘I bi Christ wey bi di Mezaya’ and dem go deceive many pipol.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 24:5
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But God ansa, “Doz profet dey lie with my name; I nor send dem or tell dem sey make dem tell di pipol anytin. Nor bi mi give dem di vishon wey dem dey tok about and wetin dem tok, na di yuzles tins wey dem tink for dia own mind.


God sey, “I nor send all dis profets, but dem dey rush go tok dia own message. I nor tell dem anytin, but dem still dey profesai.


“I know evritin wey doz profets tok; dem dey lie with my name sey I tok to dem thru dreams.


So mi wey bi God dey warn una naw sey, make una nor deceive unasef sey Babilon sojas nor go kom back kon attack una, bikos dem go really kom back.


Many wayo profets go kom and dem go deceive many pipol.


Lie-lie messiahs and profets go kom do big-big mirakles take deceive pipol. If e possibol sef, dem go deceive pipol wey God choose.


I kom with my Papa name and una nor gri asept mi, but if anoda pesin kom with en own name, una go asept am.


Na dis make mi sey una go die inside una sin. Unless una bilive sey, ‘Na mi bi di pesin wey I tok sey I bi’, una go die inside una sin.”


Den Jesus sey, “Wen una don karry mi put for cross, una go know who I bi. I nor just dey do anytin wey I like, but I dey always do wetin my Papa tell mi.


My shidren, di world don dey end and just as una hear sey, anti-Christ dey kom, make una know sey many anti-Christ don already kom. And dis show us sey di world go soon end.


Na who dey lie? Na di pesin wey sey Jesus nor bi di Mezaya! Di pesin wey rijet di Papa and en Pikin, na Christ enemy.


But evribody wey nor gri sey Jesus na Oga God, dat pesin spirit nor kom from God. Dat na di anti-Christ spirit wey una hear sey dey kom and e don already dey dis world.


Evritin for dis eart go woship am, even doz wey dia name nor dey for God Lamb book wey get life.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ