Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 24:45 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

45 “Who bi di savant wey wise and good? Na di pesin wey en oga make leader among di oda savants, so dat e go give dem food for di korrect time.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 24:45
28 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So all di pipol wey fit work wey dey di sanctuary leave dia work.


Just as king dey happy for en wise savant, na so too e dey vex for doz wey disgrace am.


Pesin wey dey tok trut, go live betta and happy life, but dem go ponish yu, if yu dey hurry to get money.


“Man pikin, go tok against di leaders for Israel. Tell dem sey mi wey bi God sey: ‘Una wey dey kare for Israel pipol, una own don finish! Una guide unasef kon leave Israel pipol on dia own.


Den di man kon tell mi, “Na dis bi di kishin where di temple savant go for boil di sakrifice meat wey di pipol offa.”


“Si! I dey send una go like sheep for where plenty wiked animals dey, so make una dey wise like snake and gentol like dove.


Den Jesus kom tell dem, “Anybody wey dey tisha di law and e bi disciple for God Kingdom, go bi like pesin wey get house kon bring new and old tins kom out from inside di house.”


E go good for dat savant wen en oga go kom back kon si am dey work.


“En oga kon tell am, ‘Yu bi good and wise savant and yu do well! Since yu fit use di small tin wey I give yu, e show sey yu go fit kontrol big-big tins. Make yu kom enjoy with mi!’


“En oga tell am, ‘Yu bi good and wise savant and yu do well! Since yu fit use di small tin wey I give yu, e show sey yu go fit kontrol big-big tins. Make yu kon enjoy with mi!’


“Pesin wey hear my word and do wetin I tok, e bi like wise man wey build en house on-top rock.


“Di oga kon tell am, ‘Yu do well, yu bi good savant! Bikos yu dey faithful with small tin, I go make yu oga ova ten towns.’


Make una take kare of unasef and all di pipol wey di Holy Spirit don put under una, bikos na una bi di leaders for God church wey E buy with en only pikin blood.


I tank Christ awa Oga God, wey give mi pawa to do en work. Even doh I dey tok bad about am and dey opress en pipol before,


Di tins wey yu hear mi tok for pipol present, make yu tish oda pipol wey yu trust sey dem dey ready to tish odas.


True-true, Moses really obey God as savant and e tok about some tins wey God go tok about leta.


I know sey yu dey stay for where Satan throne dey. But yu still whole my name strong well-well and yu nor deny mi even wen dem kill my savant Antipas for where Satan dey stay.


Di savant ansa, “Na di Moab woman wey follow Naomi kom back.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ