44 So, make una dey ready, bikos Man Pikin go kom for di time wen una nor tink sey e go kom.
Just as tonda lite dey kom from east go west, na so e go bi wen Man Pikin go kom.
“So, make una shine una eye, bikos una nor know di day wen Christ go kom.
But make una remember sey: If pesin wey get house know di time wen tif go kom for nite, e go ready ensef make di tif nor for enter en house.
“Wen dem go buy, di man wey won marry kon kom and di ones wey dey ready kon enter di party with am and dem kon lock di door.
“So, make una dey ready, bikos una nor know di day or time wen Christ go kom.”
But make una know sey, if di owner of di house know wen tif dey kom, e nor go let di tif break enter en house.
Una must dey ready too, bikos Man Pikin go kom wen nobody dey espect am.”
But make una dey shine una eye evritime, dey pray make God give una pawa take pass all dis test wey go happen, so dat una go fit stand for Man Pikin front.”
Make evribody know sey una nor like wahala, bikos Jesus go soon kom.
My brodas and sistas, make una nor dey komplain about each oda, so dat dem nor go judge una, bikos God wey bi di judge, stand near di gate.
Make wi happy well-well kon gi-am glory, bikos di Lamb marriage don rish and di pesin wey E won marry, don ready too.”