Mi wey bi Israel God dey warn una. Make una nor let di profets wey dey stay among una or any oda pesin wey klaim sey e dey si tumoro, deceive una. Make una nor listin to dia dreams.
Bikos fake christs and profets go kom and dem go do signs and mirakles wey bi like majik to deceive pipol. If to sey e possibol, dem go deceive di pipol wey God don choose.
Jesus ansa, “Make una shine una eye, so dat nobody go deceive una. Bikos many pipol go kom prish with my name sey, ‘Na mi bi Jesus’ or ‘Di time don near.’ Make una nor follow dem!
So make wi nor bi like shidren wey breeze dey karry up-and-down; shidren wey dey follow yeye tins wey human being dey tish and na dis tins dem dey take deceive pipol.
Make una nor let doz wey dey pritend and woship angels judge una. Dat kind pesin dey tok anyhow about vishon wey e sey e si, but na yeye tins and sin full en mind.
Make una take kare and nor let anybody fool una with wayo tok about human being wisdom and spiritual pawas wey dey rule di world, but make una dey do as Christ wont.
My friends, make una nor bilive evribody wey sey na God Spirit dey tok thru am. Una must test am to know weda na God Spirit e really get. Bikos many fake profets dey for dis world.