Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 24:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

30 “Den Man Pikin sign go appear for heaven and all di tribes for dis world, go kry. Dem go si God Pikin dey kom from inside di kloud for heaven with pawa and betta glory.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 24:30
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

As I still dey look for di vishon for nite, I si wetin bi like human being. E dey waka kom with kloud wey dey round am, den e go show ensef give di Pesin wey dey live forever.


“Den I go pour my spirit to pray and to show mesi for David shidren-shidren body and di oda pipol for Jerusalem. Dem go dey look mi, di pesin wey dem shuk, den dem go mourn like pesin wey dey mourn en only pikin. Dem go kry well-well like sey na dia first boy pikin die.


For dat time, di kry for Jerusalem go heavy pass Hadad-Rimmon wey dey near Megiddo own.


As Jesus sidan for Mount Olives, en disciples kom meet am for korna ask am, “Make yu tell us wen dis tins go happen? How wi go take know sey di time wen yu go kom, don rish?”


Just like e happen for Noah time, na so Man Pikin go take kom.


Dem nor know wetin dey happen until wota kom karry dem go. Na like dat e go bi wen Man Pikin go kom.


Jesus ansa am, “Yu don tok am. But I tell yu, from naw go, yu go si Man Pikin sidan for God rite hand dey kom down for kloud from heaven.”


“Den evribody go si Man Pikin dey kom from inside kloud with strong pawa and glory.


“Make yu tell us wish time dis tins go happen and wetin go bi di sign to show sey di time for dis tins to happen, don rish?”


Den, dem go si Man Pikin dey kom inside kloud with pawa and glory.


But from naw go, Man Pikin go sidan for God rite hand where pawa dey.”


kon sey, “Galilee pipol, na wetin make una stand der dey look heaven like dat? Dis Jesus Christ wey God don karry go heaven today, go still kom back di same way wey una si am dey go heaven.”


And una wey dey sofa so, God go give wi and una rest wen Christ go kom from heaven with en mighty angels.


(Make una look! E dey kom back inside di kloud and evry eye go si am. Even doz wey shuk am and all di tribes wey dey dis eart, go kry bikos of am. Dis tins go really happen! Amen.)


Den one big sign kon appear for heaven: I si one woman wey take sun tie en body like klot, di moon dey under en leg and one crown with twelf stars, dey for en head.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ