Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 24:29 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

29 “Afta di wahala wey go happen for dat time, “Di sun go kon dark and di moon nor go shine; stars go fall from heaven and heaven go dey shake.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 24:29
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Remember am before di sun, moon and stars go dark and before kloud disappear wen rain don fall finish.


True-true, all di stars and oda tins wey dey shine, go stop to shine. Di sun go dark as soon as e won kom out and di moon nor go give any lite again.


Di moon go dey dark and sun nor go shine again, bikos Oga God wey dey lead heaven sojas, go rule from Mount Zion for Jerusalem and evribody go si en glory wey big well-well.


All di stars go vanish komot, di sky go disappear like book wey dem klose and di stars go fall like dry leaf wey fall from vine or fig tree.


Di eart and sky dey shake as dem dey kom. Di sun and di moon kon dark wons and stars nor shine again.


Di sun and moon don dark and di stars nor dey shine again.


Instead make God day bring lite, na darkness go follow am kom. Dat day nor go good at-all, bikos e go dark well-well.


For dat day, I go make di sun vanish for aftanoon and darkness go dey di eart for day time.” Oga God don tok.


bikos for dat time, di sofa wey go dey, go strong pass any sofa wey don happen since wen God kreate di world kom rish naw and dis kind sofa, nor go dey again.


Wen dis tins go dey happen, e go bi like wen belle dey pain woman wey won born.”


Di day wen God go kom, go bi like wen tif dey kom for nite. Wen E kom, di heaven go disappear with loud nois and di stars for up go melt, di whole eart and evritin wey dey inside, go vanish.


Den di fourt angel blow en trumpet and wen dem divide di sun, moon and stars into three, dem fall for one part and di part kon dark. So if dem divide day and nite into three, one part for di day nor get sun again and one part for di nite, moon and star nor kon dey shine again.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ