Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 23:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 “All wetin dem dey do, na make pipol for si dem. Dem dey tie tins wey dem rite God word put for dia fore head and hand, so dat pipol go si dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 23:5
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jehu kon tell am, “Follow mi, so dat yu go si how I dey sirious about God work.” So Jehu karry Jehonadab follow body.


Dis go bi like sign wey una put for una hand and fore head, so dat Oga God law go dey una mout, bikos na with en strong hand E take karry una komot Egypt.


So make yu always get faith and dey honbol; tie trut and mesi round yor neck kon rite dem for yor heart.


Di priest go look di sore again for di sevent day, if e neva spread or yellow and e nor deep pass di skin wey dey near am,


One woman wey blood dey rush komot for en body for twelf years kon kom Jesus back, den e tosh en klot korna.


But Jesus tell dem, “Na una dey make unasef good for pipol eye, but God know una heart. Bikos wetin human being value well-well, naim God nor like.


Dem dey sofa wimen wey dia husband don die and kollect dia tins kon dey pray long prayer make pipol for si dem. So na dia ponishment go big pass.”


Bikos Jew pipol like make pipol dey praiz dem pass wetin God tink about dem.


How una go fit bilive wen una dey praiz each oda and una nor kare for di praiz wey only God fit give.


Anybody wey dey tok with en own pawa, go wont make pipol praiz am, but di pesin wey won honor who send am, naim dey do wetin korrect and sin nor dey inside am.


So make una keep dis kommand for una mind. Make una tie dem for una hand kon wear dem for una head, so dat una go remember dem.


Una must fold una kover klot for di four korna.


Make una tie dem for una hand kon wear dem for una fore head, so dat una go dey remember dem.


True-true, na jealousy and kworel make some dey prish about Christ, but odas dey do am with betta mind.


Make una nor dey karry body up, but make una trit each oda like unasef. Instead, una dey do wetin una like, bikos of di tins wey una go gain, so dat una go fit boast.


E go oppoz and karry ensef pass God and oda tins wey pipol dey woship. E go even sidan for God Temple dey tok sey e bi God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ