Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 23:35 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

35 So all God pipol blood wey una kill for dis world, go dey una head. From Abel blood go rish Zekaraya wey bi Barakaya pikin, wey una kill for inside di temple.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 23:35
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Kain kon tell en broda Abel sey, “Make wi go di field.” As dem dey di field, Kain rush en broda Abel kon kill-am.


Manasseh still kill many innocent pipol and dia blood don stain Jerusalem from one end go rish di oda end. E even still dey enkourage Judah pipol to sin against God.


Manasseh kill pipol wey nor do anytin and dia blood don stain Jerusalem, so God nor gri forgive dem.


Make dem bigin kill di king sons, bikos of dia grand-grand papa sin. No one among dem go rule for dis world or build towns again.


bikos God dey kom from where E dey stay for heaven kon ponish pipol bikos of dia sins. Di eart go show all di innocent pipol blood wey dem share on-top am and e nor go ever forget di innocent pipol wey dem kill.


“Even as I ponish una shidren rish, dem nor gri shange or listin as I dey korrect dem. Just as lion dey kill en enemy, na so too una don kill una profets finish.”


Poor and innocent pipol blood don stain una klot, even doh una nor katch dem dey tif for una house. Yet, with all dis tins wey una don do,


But make una know sey, if una kill mi, una and di pipol for dis town nor go get rest, bikos una don kill innocent pesin wey God send kom warn una.”


Dem bring am kon give King Jehoiakim wey kill and beri am for where dem dey beri ordinary pipol put.)


So, as I just tok finish, dem kon seize mi dey shaut, “Wi suppose kill yu, bikos of dis rubbish wey yu dey tok so!


For di eight mont for di sekond year wey Darius dey rule for Persia, God give dis message to Profet Zekaraya, Berekaya pikin wey Iddo bi en grand-papa.


“ ‘If una do like dat, una go spoil di land where una dey stay. Di pesin wey kill pesin dey spoil di land and unless dem kill-am, dem nor go fit klean di land where dem for kill pesin.


From wen dem kill Abel go rish di time wen dem kill Zekaraya for di altar inside di temple, dia blood dey dis pipol head and God go judge dem.


E ask dem, “Wi kommand una sey make una nor tish pipol about dis name, but si naw, di whole Jerusalem don full with di tins wey una dey tish. Una won put dis man blood for awa head?”


Na faith make Abel give God sakrifice wey betta pass Kain own and na thru dis faith Abel take know sey God asept en ofrin, bikos God really asept am. Even doh Abel don die, en blood still dey tok for am, bikos of en faith.


Una don kom meet Jesus, di pesin wey God use take start di new kovenant with en pipol and una don kom meet di blood wey dem spray and dis blood dey tok betta word wey pass Abel own.


God pipol, di profets and doz wey yu kill for dis world, God don si dia blood inside yu.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ