Yu don show betta love to many-many pipol and Yu don still ponish pipol, bikos of dia papa and mama sin. Yu bi great God wey get pawa well-well and Yu dey rule evritin.
“Man pikin, yu don ready to judge dem? Yu don ready to judge all of dem naw? Den, make yu judge dem. Remind dem about all di bad-bad tins wey dia papa don do before.
Dem even try to stop us, so dat wi nor go prish di message wey go give salvashon to Gentile pipol. As dem dey do so, dia sins dey plenty more-more. But naw, God vexnashon with ponishment dey kom meet dem.