3 So make una listin and do wetin dem dey tell una. But nor do wetin dem dey do, bikos dem nor dey do wetin dem dey tish.
God still help di pipol kom togeda for Judah, bikos dem obey di king and en ofisas kommand.
If yu do dis tin and if na God really kommand yu, den di work go eazy for yu and di pipol go happy go house.”
“Di papa kon tell di oda boy di same tin. Dis one kon ansa, ‘I go-go sir,’ but e nor go.
“Na di law tishas and Farisee pipol dey tok wetin Moses Law mean.
Dem dey put heavy load for pipol shoulder and dem nor ready to help dem.
But Pita and di apostles ansa, “Wi go must obey God instead of human being.
Make evribody obey di pipol wey dey rule dem. Bikos na only God dey give authority and put pipol for pawa.
Si! I don tish una di rules and law, just as God tell mi, so dat una go dey do dem for di land wey una won enter go stay.
Make una go by unasef kon listin to wetin God dey tok. Den make una kon tell us evritin wey E tell una and wi go listin and obey.”
If yu look dem well-well, dem bi like God pipol, but dem don rijet God pawa. So make yu run from dis kind pipol.
Dis kind pipol dey sey dem know God, but di way wey dem dey live dia life, show sey dem nor know am, bikos dem get bad mind, dey disobey God and dem nor ever dey like betta tin.