Make wiked pipol turn from dia wiked life kon shange di way dem dey tink. Make dem turn go meet di Oga wey bi awa God, bikos E dey sorry for pesin and dey kwik forgive pipol.
Jerusalem pipol! I don si as una dey do ashawo waka and as una dey run follow difren juju for fields and for evry hill. Naw, make una si di wahala wey dey wait una. So, una go ever dey klean to woship mi again?
“So Jerusalem pipol, make una from una heart stop all di bad-bad tins wey una dey do, so dat una go dey save. Wetin make una nor fit stop to tink bad-bad tins?
And wen dem kom back from market, dem nor dey chop unless dem first wosh dia hand. Dem still dey follow many oda tradishons, like to wosh cup, kettol and chair wey dem dey sidan put chop.)
Wen pesin dey good, na di good tins wey dey inside am, dey make am bear good fruits, but bad pesin, na di bad tins wey dey inside am, dey am make bear bad fruits, bikos na from wetin full inside pesin mind, naim en mout dey tok.
So, as God don promise us all dis tins, make wi wosh awasef komot from evritin wey go fit make awa body or awa soul dirty, so dat wi go dey holy as wi dey respet God.