20 So, anybody wey take di altar swear, na both di altar and evritin wey dey inside, e take swear.
Una blind o-o! Wish one big pass, na di gift or di altar wey make di gift holy?
And anybody wey take di temple swear, na both di temple and God wey dey stay inside, e take swear.
Wen pipol won setol matter, dem dey swear with pesin wey big pass dem and di agriment wey dem make, dey end di matter.