Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 23:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey use long prayer shit wimen wey dia husband don die, bikos of dis, God go ponish una well-well.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 23:14
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Nor bi only sey yu nor gri help wimen wey nor get husband again, but yu dey ponish and kollect from shidren wey dia papa and mama don die.


I dey always help poor pipol; I neva let wimen wey nor get husband live for pain


“Make una nor sofa wimen wey dia husband don die or shidren wey nor get papa and mama.


But I tell una, God go get mesi for Sodom pass una for judgement day!”


“But e go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una klose door make pipol nor for fit enter God Kingdom! Unasef nor won enter and una nor won make odas enter.


“Una bi snake! Wiked snake shidren! How una go take eskape hell?


Woman wey en husband don die, dem dey kollect en propaty and dem dey pray long prayer make pipol for si dem. Na dia ponishment go worse pass.”


But di savant wey nor know wetin en oga wont and e do tins wey go make dem flog am, dem go flog am small. Pesin wey God give plenty tins to, E go ask plenty tins from am and di ones wey God give plenty, E go ask doubol from dem.”


Dem dey sofa wimen wey dia husband don die and kollect dia tins kon dey pray long prayer make pipol for si dem. So na dia ponishment go big pass.”


Bikos na dis pipol dey hide enter pipol house kon sleep with wimen wey nor get sense; wey dey sin well-well and wetin dey sweet dis wimen to do, na-im dey kontrol dem.


Many pipol nor won do wetin God tok, instead, dem dey tok anyhow, dey deceive pipol and follow Jew pipol law wey sey, evribody must sekonsaiz.


My brodas and sistas, evribody nor go fit bi tisha, bikos yu know sey wi wey dey tish, na awa judgement go big pass,


Wetin dem like pass, na to sleep with who dem nor marry; dem nor dey taya to sin and dem dey draw doz wey dia faith nor strong, follow body. Dem don train dia mind to get long-trot and God don curse dem.


and dis tishas go deceive una with dia wayo. God don kondemn dem tey-tey and Christ wey go distroy dem, nor dey sleep.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ