Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 23:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Anybody wey dey karry body up, God go bring am down and anybody wey nor dey karry body up, God go raiz am up.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 23:12
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God dey save pipol wey dey honbol, but doz wey feel sey dem wise, E dey disgrace dem.


Even doh God dey great, E dey kare for di pipol wey dey honbol demsef, but doz wey dey karry body up, e dey give dem shance.


To fear God, dey bring wisdom and to honbol yorsef, dey bring honor.


Pesin pride go distroy am, but if e dey honbol, pipol go respet am.


Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.


Naw, mi Nebukadnezzar praiz, woship and hail di King wey dey heaven. Evritin wey E dey do dey rite and en ways dey pure. Pipol wey dey karry body up, E dey bring dem down.


Anybody wey bring ensef down like dis small pikin, naim big pass for God Kingdom.


“God go bless una wey dey poor for spirit, na una go get heaven.


Anybody wey dey karry body up, dem go bring am down and anybody wey put en body for groun, dem go karry am up.”


“I tell una true word, na di tax kollector God go forgive, nor bi di Farisee. Bikos anybody wey karry ensef go up, God go bring am down, but di pesin wey put ensef down, God go karry am up.”


But E give us plenty grace. Na dis make God word sey, “God dey against pesin wey dey karry body up, but E dey give grace to pipol wey dey put dia body down.”


For di same way, make una wey yong put body down for di eldas. Make una nor dey karry body up for each oda, bikos God dey oppoz proud pipol, but E dey favor doz wey dey honbol.


Make una put una body for groun bikos of God and wen di rite time rish, E go karry una up.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ