11 Di pesin wey big pass among una, go bi una savant.
Make yu nor let pipol koll yu ‘Leader’, bikos na only one leader una get and na-im bi Christ.
Afta Jesus sidan, e koll en twelf disciples kon tell dem, “If anybody among una won bi first, e go bi di last and e go bi evribody savant.”
I nor bi anybody savant. But I don turn savant to evribody, so dat I go fit win many pipol for Christ.
Na Christ savants bi? (I don dey tok like sey I dey kraze again!) Misef na Christ savant wey betta pass dem! I don work hard pass dem, I don dey prison plenty times pass dem, dem don beat mi well-well pass dem, I don nearly die plenty times.
Wi nor dey tok about awasef, but wi dey prish sey, na Jesus Christ bi Oga God and wi bi una slave, bikos of am.
My brodas and sistas, God don koll una make una dey free; but make una nor use di freedom wey God give una anyhow, instead make una love each oda.