Den Lot go tell di men wey won marry en dotas sey, “Make una kwik-kwik komot from dis town, bikos God won distroy am!” But dem tink sey Lot dey lie for dem.
Di seed wey fall for shuku-shuku, na pesin wey hear God word, but wahala, long-trot and to kwik get money for dis world kon shuk di word die for en heart and e nor kon bear fruit.
“Den e send oda savants sey, ‘Make una go tell di pipol wey wi invite sey, “Si! Di party go soon start. I don kill big melu and oda animals and evritin don ready, so make una kom for di marriage.” ’
Fear katch Felix, as Paul dey tok about di Good News, sef kontrol and how God judgement go take kom, so e kon tell Paul, “Make yu go first, wen I get time, I go sey make dem bring yu kom again.”