46 So nobody fit ansa Jesus and from dat day go, nobody try to ask am kweshon again.
So dem ansa Jesus, “Wi nor know.” Jesus kon tell dem, “Misef nor go tell una wish pawa I take dey do all dis tins.”
If David koll am, ‘Oga God,’ den, how e kom take bi David pikin?”
Wen Jesus si sey di man tink well before e ansa, e kon tell di man, “Yu nor dey far from God Kingdom.” From dat time, nobody get di mind to ask am any kweshon again.
Wen Jesus tok dis tin, shame katch all en enemies, so di pipol kon dey happy, bikos of wetin Jesus dey do.
Dem nor tok anytin. Naim Jesus hold di man, heal am kon sey make e dey go.
But dem nor fit ansa.
So dem nor dare ask Jesus kweshon again.
As dem si sey di man wey God heal stand der with Pita and John, dem nor fit deny wetin happen.
‘Na mi bi di God wey yor grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob dey woship.’ Moses start to shake and fear nor let am look too mush.