Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 22:44 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

44 “Di OGA tell my Oga God sey, ‘Sidan for my rite hand, until I go put all yor enemies under yor leg.’

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 22:44
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go make yu hate woman and yor pikin go still hate pikin wey woman born. Pikin wey woman born go mash yor head and yu go bite dia leg.”


Di OGA tell my Oga God, “Make Yu sidan for where honor dey for my rite hand, until I don put all yor enemies under yor leg.”


Wen Yu appear, Yu go trow dem put for fire wey dey burn well-well. God go vex distroy dem for di fire.


If David koll am, ‘Oga God,’ den, how e kom take bi David pikin?”


Jesus ansa am, “Yu don tok am. But I tell yu, from naw go, yu go si Man Pikin sidan for God rite hand dey kom down for kloud from heaven.”


Afta Jesus don tok to dem finish, God kon karry am go heaven and e sidan for God rite side.


But doz my enemy wey nor wont make I bi dia king, make una go bring and kill dem for my front!’ ”


Tomas ansa am, “O! My Oga God and my God.”


To God holy pipol for di church wey dey Korint, wey bi en own bikos of Jesus Christ and pipol for evriwhere wey dey woship awa Oga God Jesus Christ as dia Oga God and Savior.


Christ go rule until e don put all en enemies under en pawa


Nor bi only doz ones, but naw, I dey look evritin as nor-tin, wen I kompare am with Christ, my Oga God wey I know and I trowey evritin, bikos of am. True-true, I dey look all doz tins as yeye, so dat I go fit gain Christ,


Na wish angel God tell, “Sidan for my rite hand until I go put all yor enemies under yor leg?”


Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.


Make wi dey look Jesus Christ wey give us awa faith and go help us keep am. Bikos of di joy wey Jesus dey espect, e sofa for cross and nor mind di shame wey follow am. But naw, e don sidan for di rite hand side for God throne.


Den I si di beast, di kings wey dey di world, dia sojas, as all of dem gada to fight di Pesin wey dey ride di horse and en sojas.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ